I No Send You and Yours
If you dey in love, I no like you
This una love story for make sense
But both of una no sabi English
Na why you resort to empty hailing
Talmabout 'Prince of my heart'
Olodo, the human heart is divided
But in chambers not kingdoms
No words could make better imagery of a heart in love than: chambers, cuspids (bi-&-tri-cuspid valves) ...
But you no know about that one
Him self post you with 'she makes my heart beat'
Una just dey berate cardiologists.
Let's even say each chamber stands for a kingdom
Is he the prince of four kingdoms like Nollywood producers would title their films?
Or he is the prince of one chamber?
If so, who then rules the rest?
Shey I been tell you say one day you go expose yourself?
This una outing for oppress me
But your boyfriend no sabi dress
Why he go wear red shirt on top skintight red jeans come siddon on top red chair for restaurant wey them decorate with red lights?
He dey run apprentice for native doctor?
This una love life for hungry me
But I sabi whom your boyfriend dey date
And e no be you
Una dey do tiktok video with ring light
But he no fit put a ring on it
As you sleep on that decorated room
Know say person no like you and yours
For me, anybody wey dey in love no wise



πππ Onyeka ehh
ReplyDeleteThis was hilarious π. Well done dancing penπ
ReplyDelete